SHARPBET✅
SHARPBET✅
February 13, 2025 at 07:10 PM
Because today na Thursday make we tok about Victor Moses matter and we go still appreciate Victor Moses join because e no easy. Some people no know say dem born Victor Moses for Naija, well dem born Victor Moses for Kaduna and hin papa name na Austin while hin mama name na Josephine. Victor Moses na orphan and wetin happen be say dem kpai hin papa wey be Pastor during di 2002 Relig!0us ri0ts wey shele in Kaduna wey kpai over 250 people. Dem find Victor Moses parents come house come kpai them and luckily Victor Moses dey outside dey play ball and e bin dey 11 years then. Na one of hin uncle later hide am for one week come gather money send am go UK make e go seek Asylum there. Victor Moses no sabi anything, e no sabi anybody na why dem keep am for foster care. Na G0d help am e later make am through football in fact before e go turn 16 e don already play hin professional match for Crystal Palace because dem say e score more than 50 goals in a season for Crystal Palace U-14. But after everything wey happen, Victor Moses still represent Nigeria in fact di bobo win 2013 AFCON for us. My people abeg make una appreciate Victor Moses because some people go dey avoid Naija anytime wey dem remember their parents.

Comments