LEAP-Fi |Paul Aremo-Oluwa
LEAP-Fi |Paul Aremo-Oluwa
May 23, 2025 at 12:23 PM
Nobody is born with wings. So nobody is destined to fly without obeying laws. Same with money—*if you ignore the principles, money go ignore you too.* Now hear this: if your relationship with money na correct one, e go stay. But if you treat money anyhow, it go do you anyhow. Let me yarn you true: poor people no get money wahala because them offend one spiritual elder. Most times, *na poor relationship with money dey cause am*. If you sabi how money dey behave, you fit toast am well and e go even bring e friends come meet you. *Law Number One: Be Financially Literate.* No be say make you carry calculator everywhere, but understand how money dey move, how to make am grow, and how not to chase am away like your ex. You need to sabi money like say na babe wey dey vex easily. If you press her red button, wahala go burst. But if you study her, treat her well, she go stick with you like glue. The rich no just wake up one day begin see alert anyhow. They pay attention. Them dey read books, ask questions, attend seminars—even listen to those long YouTube money guys wey dey talk with British accent. *Money is a jealous lover*—if you ignore her or treat her anyhow, she go leave you with loud “God when?” moments. But if you study her, respect her, use her well, *she go multiply inside your account like pure water business in hot weather.* So stop waiting for one mysterious destiny to make you rich. *Na principle go help you, no be prophecy alone.* You wan blow? Understand money. Learn her language. And treat her like Queen Sheba in Solomon's Palace— *with sense and intention.*
❤️ 1

Comments