
Joshspot Tv - Stories
June 19, 2025 at 05:03 AM
*"I found out my girlfriend is a witch. Nah why i never make am😭"*
Sometimes ago, I stepped out for a party with my friends. It was a very nice party, plenty girls dey. That was how I sighted this babe(my girlfriend) , walked up to her and immediately started shooting my shot she been dey play hard to get...e pass my power I con hands off, go dey chill with other babes
Omo naso she pull up oh, collect my phone from my pocket put her number save am with 'babe'...with love emoji fah, from there we start dey talk oh, but ehh down the line found she was obsessive as f*¢k we been start dey date Sha, I been just dey feel say nah asper she too like me nah
See ehh if nah f*¢k ehh this babe sabi, like she go do some kind moves wey p*#$nstars sef e sure me Dem no sabi, nah weytin she use hook me, I got tired of the relationship Sha, she been no con dey allow me associate with my female friends even purely platonic ones oh, the one wey been shock me pass
Nah when my colleague for work been dey follow me talk oh, out of nowhere my babe call me oh start dey para say sheybi instead of make I work i dey follow woman talk, I say how she take know say I dey talk with woman, Omo I got cold from there, but ehh still my mimu mind no tell me say something fishys going on
Because of better opueh and as she set full everywhere I lock up, Omo josh make we Sha dey know the kind babes we let into our lives oh, cause some sef ain't human walai, this one nah from personal experience oh, Sha 2 years into the relationship I was a walking shell of myself, he like nah float I been dey float for life I blocked my friends and family
Nah just me and the babe oh, I no hrt anybody wey I dey talk to again nah just her, I was depressed, running crazy inside my head, I got fired from work, nah she be the only source of income for the both of us, I was now like the bitch in the relationship, she go Comot go work, me I go stay dey cook dey clean
But as they say 99 days for the thief and one day for the owner, I was cleaning the house as usual I con dey here rat for our ceiling Omo I advance oh use chair climb, I been see one small opening, I drag am Comot Omo next thing I see nah carton oh, I fall am out nah, e been look suspicious somehow, I say make I check to see weytin dey there, e fit be money
Josh ehh I was so wrong, I saw like a calabash pot with period stained pant, my picture, weytin resemble hair and padlock, my mouth lock, I been wan shout Jesus but nothing fit fallout, I took everything like that to the nearest church in my street then, I'll never forget the pastor, but ehh e be like the forces been too strong
He gats carry me go him own father in the lord Omo nah the two join hand pray for me oh, I never went back to the house oh to get my things, from there I stayed with the pastor, I reconnected with my family, things has picked up in my life, but ehh this is something that if it didn't happen to me I go think say nah Nollywood film
But Omo there are things out there oh, make everybody dey strapped oh, especially we guys...you fit dey toast person you go think say nah babe, but nah marine spirit, nah my own I say make I talk put for here, maybe person fit learn from me
👍
😂
😮
😢
🙏
❤️
💔
❤
💀
😨
256