Esᴄᴀᴘᴀᴅᴇs STORIES 🌻😍🥰✨💫🔥
Esᴄᴀᴘᴀᴅᴇs STORIES 🌻😍🥰✨💫🔥
June 14, 2025 at 06:52 PM
7 TRUTHS WEH GO CHANGE YOUR LIFE IF YOU TAKE AM I no go lie give you, sometimes, na we dey use our own hand hold our destiny for neck. No be village people this time. No be your enemies. No be your background. Na YOU. Yes, you wey dey read this now. Make I yarn you 7 bitter-sweet truths. 1. You dey fear wetin people go talk. You wan start something but you dey shake say, “Wetin dem go talk?” Guess what? Dem go talk whether you do or not. 2. You no dey invest for yourself. If dem check your phone now, you go don spend ₦30k for data in one month watching Comedy skits, but training of ₦10k wey fit open your eyes, you go say “I no get money.” No be money you no get. Na priority. 3. You dey scroll social media anyhow. Instagram, Facebook, TikTok, you sabi the latest gist. But you no dey build anything. You dey scroll people wey dey cash out while you dey “laugh and like” with empty bank account. Abeg, build your own online presence. Start making your own money 4. You get something wey you sabi, but you dey hide am. You sabi bake, sew, talk, write, design, advise, organise, but you dey keep quiet. My sister, people dey cash out from wetin you dey do for free. Wake up! Teach. Coach. Sell. Package that skill! 5. You dey wait for perfect time. You dey say, “When I get money… When I get time…” Hanty, perfect time no exist. Start with that small one. Learn as you go. God dey help people wey dey move, not people wey dey sleep. 6. You dey look down on yourself. You dey talk say, “Who go buy from me?” “Who I be to teach others?” See eh, people wey no reach you dey collect millions from people. Confidence dey open doors wey certificate no fit open. Shine your shoe. Lift your head. You be full spec. 7. You never take yourself serious. You dey wait for people to take you serious, but you dey play with your gift. Until you treat yourself like a brand, nobody go respect you. Stop wasting potential. Stop forming humble to the point of suffering. Na you dey hold yourself down. But today, you fit decide say enough is enough. You fit learn how to package your knowledge and cash out. You fit turn your smartphone to ATM. You fit build a personal brand wey dey bring income, impact, and influence. And I go show you how inside my coaching and training class Value choke. Transformation guaranteed. I dey wait for you! Development Coach/Management Consultant. I teach women personal development and how to build 7 figure online brands with their knowledge, skills, experiences and expertise. To get started join the community https://chat.whatsapp.com/HiMUSs664nj7fJicczwWbY
❤️ 👍 3

Comments