
BBC News Pidgin
378.8K subscribers
Verified ChannelAbout BBC News Pidgin
Welcome to BBC News Pidgin WhatsApp channel. You fit check out how we dey protect your sensitive information. https://www.bbc.com/pidgin/articles/clyrk0r2wg9o
Similar Channels
Swipe to see more
Posts

Inside video wey trend, Oshiomole call for di investigation of di airline but Air Peace don insist say dem no do anytin wrong. Na to see how e go take end now wey Minister of Aviation don chook mouth for di mata https://www.bbc.com/pidgin/articles/cjdzmlzz3l9o?at_campaign=ws_whatsapp

Madam Kiobel say she go like make di Nigerian goment retry dat case as dem as families of di Ogoni 9 go through a lot and survive by di grace of God. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0j7xgv8p3vo?at_campaign=ws_whatsapp

Di Israeli military tok say Iran launch missiles towards Israel just now, and dia defence systems dey work to stop di threat and dem don tell dia pipo to go hide. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cwyv5q02zdxo?at_campaign=ws_whatsapp

Dis na di latest for di goment Operation Recovery All Loot (ORAL) agenda wey dey target to collect all moni and properties wey former goment appointees tiff. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cdd21eq02ggo?at_campaign=ws_whatsapp

Di plane wey bin dey carry 242 pipo crash 30 seconds afta take-off and claim 241 lives. Aviation experts and pilots don tok wetin fit cause di crash. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c5ye1xq0q72o?at_campaign=ws_whatsapp

Dis dey make pipo worry say we fit dey face anoda period wey di price of energy go rise, and dat automatically go make di price of evritin from petrol and food to holidays to go up. https://www.bbc.com/pidgin/articles/clyrlmjyvqpo?at_campaign=ws_whatsapp

Di family statement dey come afta President Bola Tinubu for im Democracy Day speech, grant presidential pardon and national honours to di famous Ogoni Nine wey dem execute under di military rule of late General Sani Abacha for 1995. https://www.bbc.com/pidgin/articles/c0j7xgv8p3vo?at_campaign=ws_whatsapp

Meet Tosin Olumade wey be aerialist and contortionist. Im kain performing art dey make pipo wonder if e get bone for bodi, and na why dem dey call am Boneless. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cx2qd1n9j0lo?at_campaign=ws_whatsapp

United States say dem no dey involved for Israel attacks on Iran nuclear sites and military commanders, but one tok-tok pesin for Iran armed forces say di US and Israel go pay "heavy price" for di strikes. https://www.bbc.com/pidgin/articles/cvg52lw19jpo?at_campaign=ws_whatsapp

26-year-old Osimhen dey set to return to parent club Napoli afta e score 37 goals for 41 games during dis season loan spell wit di Istanbul giants. https://www.bbc.com/pidgin/articles/ce9vmv458l8o?at_campaign=ws_whatsapp